Highlife musician Mike Ejeagha, wey he song start to reign again afta one content creator use am, don finally die on Friday nite at age 95 and di family don already bury am.
Na di senior son, Emmanuel Ejeagha, nai tell tori pipo on Sunday say dem get to bury di musician bifor di next day cus na wetin hin want bifor he die.
Emmanuel say dem bury hin papa for dem village Umuagba, Imezi-Owa, wey dey for Ezeagu Council Area of Enugu State.
He say di papa seriously warn am make he nor ever embalm he bodi so as di papa come die on Friday, na he call di whole family tell dem di mata for ground and even Enugu State Govinor, Peter Mbah, naso dem say make dem follow di wish of di singer.
For di telephone interview wey di senior son do on Sunday, na since di papa don dey draw he ear about embalming, so he get folow am cus problem for dey for front.
He laslas say di burial preparation and party dem go soon announce am.