+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Why I Pick Prof. Amupitan As INEC Chairmo —President Tinubu

‎Presido Tinubu don tok di main resin wey make am karey INEC chairman position give Professor Joash Amupitan (SAN) wey be di new man wey take over from Professor Mahmood Yakubu afta 10 years for di seat.

‎Presido say na cus di man nor get wayo or wuruwuru for he eye and e dey show for all hin records.

‎So on Thursday wey Bayo Onanuga di Special Adviser on Information and Strategy dey read Oga Presido statement nai he say di Kogi man nai be di first pesin for dem state to get dis kind position and dian deserve am.

‎As di Council members, leaders both di one wey dey service and di one wey don komot from service, come gree for di State House, say na Professor Amupitan nai fit take over from Professor Mahmood Yakubu, and make Presido karey he name go give Senate for screening.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM