One woman wey dem nor call her name don kill her husband and side babe for Ughelli afta she don dey shout about how di man nor dey use eye see any color of skirt.
Di woman wey be from Isoko, na mama of two children but police now don arrest her cus she use cutlass take finish di husband skull for dem haux wey dey for Ighwre-Ovie area for Ughelli bifor she match go meet di side chick.
Wetin one source tok be say, ei woman don tire for her husband cheating ways, so thay nite wey he come haux drunk, nai di wife karey cutlass take finish di skull. Na ground there di husband die and one of dem wonab neighbour wey run come to stop di woman, thay one kolet cut for jaw but dey hospital dey take treament.
As di woman kill husband finish her bodi nor come down, she match go di babe place wey dey same area, use hammer take bust her skull. Na God save di side chick neighbour cus hand nearly touch her but na she come dey shout, wey pipo come catch di woman karey am go Ughelli police station.
One senior security source from Delta State Police Command don confam di mata say di woman dey dem hand and investigation don start but SP Bright Edafe never chuk mouth put.
