Di video wey trend on Tuesday as one naval officer, A.M Yerima dey give am back to Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, don enta anoda level as some dey blast odas dey support.
One constitutional law expert, Prof. Sebastine Hon, SAN, give drop am wotowoto for officer Yerima say he bor get respect, make authorities purnish am and even di pipo wey send am, cus na over sabi nai do am.
But for di side of Ahmed Musa wey be Ordinary President wey dey host Brekete Family radio say Yerima nor do anytin bad as Wike own too much, cus naso odas like El-Rufai behave but today no bodi know dem again.
So e go beta make Wike beg Yerima now wey dey still break or make President Tinubu go epp Wike say sorry.
For anoda side na Joe Igbokwe and Deji Adeyanju nai dey use tok take dey fight for social media about wetin officer Yerima and Wike display.
Igbokwe say make dem sack di officer while Deji say e nor go work cus Igbokwe only dey look afta he belle.
Naso Igbokwe start to dey warn Deji say make he know wetin he dey yarn as dem two nor be mate.
