+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Workers Nor Fit Take N54k– Labour Tell FG

Nigeria Labour vex waka komot from meeting wet dem do yesterday with di tripartite committee but be like anoda one go hapun today by 4 for evening.

Wetin vex Labour na di N54k wey FG say nai dem go fit pay and anoda na govinors wey nor even gree come di meeting.

Dem say wetin federal govimet just do na to reduce di salary wey be N77k come dey ask weda tins for market dey go down abei e dey increase, cus dem nor fit sitdon just dey gree for N54k.

Di Labour come say for di meeting wey dem wan do today di six govinors from di six geo-political zones must dey for di meeting.

Even wey one member of di tripartite committee on national minimum wage dey tok, Professor Theophilus Ndubuaku say all of dem don gree say if FG nor do well by May 31 na close of everywhere cus govimet nor fit dey yeye workers for di kontri.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM