+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

World Bank Approve Loan For Nigeria Reform

Federal Govimet don get $2.25 billion loan approval from World Bank wey dem go use take stable di nation ecomomy.

Na Minister of Finance Wale Edun nai tok about di loan on Thursday say e don dey approve.

He say na fr April nai Govimet bin don go meet World Bank to ask for $2.25 billion and by June dem believe say di board go sign di approval.

Di resin wey make Nigeria go for di loan according to di Minister, na to epp di kontri foreign exchange reserve to get strength, then one portion na to use take epp pipo wey nor get, all na to make di ecomomic reform of President Tinubu work.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM