EFCC don say na yahoo boys nai dey make obodo oyibo kontri nor dey gree give Nigerians visa again afta many of di oyibo kontri make tins hard for pesin to travel to kontri.
Na cus of di issue nai make EFCC come dey warn yahoo boys, pipo wey dey tiff moni, say na dem dey make Nigeria dey smell for outside pipo nose.
Chairman of EFCC, Ola Olukoyede nai tok so for Rivers State thru hin Chief Superintendent of the EFCC, CSE Coker Oyegunle, for di event wey di Coalition of Nigerian Youth on Security and Safety Affairs organize.
He say yahoo boys dey destroy di economy of di kontri that nor bodi go wan come do business or even give youth work for dis kind place.
Nai he say instead of di young pipo to dey use dem power take dey do yahoo make dem put am for farming, digital innovation, industry, personal business wey go give beta moni wey dem go enjoy with peace of mind.