+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

You Nor Be Christian, Osei Curse NDC Presidential Candidate

Osei Keyi-Menaseh-Bonsu di member wey dey rep Suame constituency for Ghana don reply di 2024 presidential candidate of National Democratic Congress wey say he go comot tax from betting.

E never tay wey John Daramani Mahama tok say if dem put am as Presido for Ghana, youth nor go see anytin like tax for betting again so dem fit dey see Dem moni wella.

Naso Osei jump shout for Mahama say him wey be Christian dey tok like who nor dey go church, cus di resin why dem put tax for betting, cigar, alcohol and other tins na to discourage pipo so that dem go out dem mind for beta tin instead.

Nai di Majority Leader come still tell di NDC candidate say even Bible dey against betting cus nor be work and pesin wey call hesef Christian dey stand to wan comot tax from betting.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM