President Bola Ahmed Tinubu dey get am hot again afta he bring anoda pardon list but dis time pipo wey dem do drugs, trafficking, tiff and even Mariam Sanda wey kill her husband, dem name don komot from di new list.
Di gbasgbos nor be here as pipo say so presido fit hear word afta pipo start to shout day na drug baron he give pardon but wey Nigerians dey cry say di fuel subsidy, tax and other policy wan kill dem, presido no gree hear but he don quickly change di mercy list.
On Wednesday nai Bayo Onunaga wey be he media tokpesin bring di new list but as e nor go down well naso lawyer and public affairs analyst Frank Tietie sat make President Tinubu nor just try change anytin cus if you don give pardon naso e go stand.
Na for Arise New nai Tiete take dey blow hot say president for think about he action bifor he go lite di fire cus you not fit put pesin for prison, komot am, come karey am go put again. Nigeria law nor allow am like that.
Di new list say instead of Mariam Sanda and di odas wey dem give pardon to come out, dem go return back to prison to stay for 12 years but Mariam Sanda don already spend 6 years for jail.
