+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

You Nor Well For Head, Davido Blast Wizkid

Di problem wey Wizkid and Davido bin dey get be like na now nai e just wan start fully.

Na for social media nai WizKid go post some tins about Davido and di tin nor go well with Davido at all.

Na Wizkid go post video online about how Davido kneel don dey beg one lady, he come say naso fans suppose dey beg am say make he release new music base on who him be

Bifor you know, di mata don drag Don Jazzy join as Wizkid say di Marvin Record label pga na social media influencer.

Di mata come make both celebrities and fans dey dey tok plenty for inside social media.

For all di blasting an on Monday nite nai Davido come drop he own gbasgbos give Wizkid as he curse am say he nor well.

Davido and Wizkid part nor dey cross bifor but seven years for one event for Eko, Lagos, nai dem two take settle and dem dey plan new tour dis year bifor dis new quarel.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM