+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Youths For Cross Rivers Throway King Komot From Palace

Youths wey nor get joy don porchu di king of Okuku Kingdom for Ogbaniko wey dey for Yama LGA inside Cross Rivers State cus of how di king dey behave.

HRM Chief Odaji Ipuole sitdon for he palace wey youth just bust out with songs and protest say make he karey bag komot from di throne.

Dem dey shout say di behavior of di king don bring bad name come give dem for di community so e go beta make he kukuma komot.

Wetin pipo tok be say problem don dey for di community since and dem don dey go meet di king to call meeting to solve am, make everybodi for enjoy peace but for where, Ipuole turn deaf and dumb.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM