+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fake Rods Nai Dey Make Building Fall For Nigeria — Rep

Di way building just take dey fall yakata for Nigeria nowadays really reach for investigation, nai make di House of Representative come do a Committee on Steel Development na there dem take know say na fake iron rods dey curse all di problem.

Dem don use am now take dey call different stakeholders to put bodi join for di fight make di bad name stop for building industry.

On Wednesday for Abuja wey dey dey tok about di issue for di Nigerian Society of Engineers meeting, Chairman of the Committee, Zainab Gimba, say wetin dem eye see dem mouth must tok as iron rod of 10 mm na 7.56 mm nai e be, 12 mm na 9.25mm and 16 mm na 11.25mm.

The chairman say pipo go dey feel say dem don buy beta rod nor know say di quality na gbajo. She say na korokoro nai dem take bring di rod enta Nigeria every day and di supervising agencies sef nor dey do dem work well, if not all dis kind tin nor go dey hapun.

As dem don do di committee, Gimba say any bodi wey dem caught now, sorry nor dey inside di pesin must pay according to di law cus na innocent pipo nai dey suffer am.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM