+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Galatasaray don sign Super Falcons defender, Demehin

Turkey club Galatasaray don announce say dem don sign Super Falcons defender Oluwatosin Demehin.

Demehin na 22 years and she bin dey for French club Stade de Reims  before she dey enter Galatasaray with one year contract so.

She play beta part wen she dey Stade de Reims wen make dem con take 4th position for the French D1 Arkema for last season.

With two years for France ,now she don ready to carry her skill enter Turkey.

For Galatasaray, na No. 4 jersey she go wear.

Demehin bin play for Sunshine Stars and Rivers United wen she dey club for Naija.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM