+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

My Oga Allow Me Govern Well — Fubara Beg Wike

Since Govinor Siminalayi Fubara enta office take power from Nyesom Wike, dem two don dey get problem since and di gbege don dey tear everywhere.

Wey Govinor Simi come Channels TV program nai he come dey beg Wike make he nor scatter di state, so that dem nor go destroy di kontri as he don dey. If na election dem fit fight but nor be now.

Di Gov come say he remember wey Wike dey as Govinor, pipo dey envy di state but say make dem nor scatter di state as he time na either four years or eight years anoda pesin go enta.

Dis one come join di wahala wey come up bifor and afta di LGA election wey dem burn secretariat and pipo even die put.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM