+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Don Catch Marketer of Fake Amoxicillin Capsule — NAFDAC

‎Managing Director of Divine Kings Pharmacy Limited, Kingsley Ekeanyanwu don enta police net acts NAFDAC catch am cus of di fake Deekins Amoxycillin 500mg capsule wey bin dey for market.

‎Pipo wey bin take di mericin no be small shout dem complain about different tin for dem bodi until NAFDAC come kolet di drugs from market on Wednesday.

‎But wey Prof Mojisola Adeyeye dey tok to tori pipo on Thursday for Abuja, she say dem don catch Mr Kingsley and he dey for police station.

‎Dem don still karey di drugs go lab to test am, while Pharm. Ekene Christopher, Ecomed Pharma Ltd and Mr. Kingsley Ekeanyanwu wey get Devine Kings Pharmaceutical Ltd all of dem go hear word as dem don still tell pipo wey still get di drugs for haux to troway am.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM