Di 41 years pastor from Eneka Port Harcourt, Ifediorah Onyeibor Joseph, wey he video waka as he dey flog some small children, police don catch am.
Di pastor dey flog more than 20 children for di video and some nor wear cloth while dem hold palm frond for dem hand dey cry.
Peain wey post di video online say for days now naso cry di children dey cry for nite and dem never chop.
Wey police come go di church nai dem catch di pastor and some other church members, dem don even start to investigate di mata.
Wetin Rivers State Police tokpesin Grace Iringe-Koko tok be say di pastor say na 3-day spiritual cleaning program nai he dey do for di children cus na Holy Spirit nai tell am to do so.