One popular drug baba, Sunday Ibigide, wey dey in charge of drug selling for Delta State nai National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) for Asaba Don arrest as he dey go distribute 138 kilograms of drugs.
Di man wey be just 36 years don dey do too much sotay NDLEA don dey find am since 2022 but he hide until wey he dey go karey dis plenty drugs to sell.
Na tokpesin of NDLEA l, Femi Babafemi on Sunday nai tok say nor be only di drug lord dem catch as one of he aide wey be 27 years Clement Osuya, dem still arrest am join.
Bifor NDLEA fit arrest Ibigide for August 10, 2025, with over 250 kilos of drugs wey dey make pipo high and behave anyhow, dem bin don seize 24.137 kilo of hard drugs with 10 grams of Molly from am but naso he disappear until di current arrest.