+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Benue Get New Speaker Afta Old One Sack Hinsef

Benue State House of Assembly don dey hot for some time now and so speaker, Aondoana Dajoh, come look upandan with mata wey full ground nai he just sack hinsef.

‎On Friday nai Dajoh bin don suspend four of di lawmakers cus dem dey plan to komot am from position as speaker.

‎But as di speaker come kukuma use only he hand resign nai di House do emergency meeting on Sunday come vote in Alfred Berger, Makurdi North State constituency, wey join di lawmker wey Dajoh suspend on Friday make he be di new speaker.

‎Na Lami Danladi, wey bi di deputy speaker nai chair di meeting then Douglas Akya from Makurdi South come say make dem put Berger for di position nai Abu Umoru from Apa State constituency second am, naso all of dem come gree.

‎But di state governor, Hyacinth Alia don tok say make nor bodi point am finger as he nor dey for any plan to take remove Dajoh from speaker position.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM