Nigeria go soon be where every kontri for Africa go buy diabetes mericin as China dey plan to build di first medical biotechnology lab wey go dey produce insulin.
Na di Chinese ambassador to Nigeria, Yu Dunhai, nai tok so on Wednesday wey dem dey do di 76th anniversary of China for Abuja.
For di reception nai Yu say dis drug wey dem wan do so go epp fight and prevent diabetes and go make Nigeria nor dey put eye for abroad wey go bring come for dem.
Yu come dey still praise Nigeria as dem adopt Chinese language learning put for secondary skool, that na to show say di relationship wey Nigeria get with China don enta anoda level come join with say di two kontri dey do independence for October 1st.