Minister of Innovation, Science and Technology, Uche Nnaji, wey don dey get problem upandan cus of fake skool.and NYSC certificate wey Premium Times newspaper say he get, don make di minister resign from position.
Na on Tuesday nite nai di minister send he own sack letter ho give President Bola Tinubu and Bayo Onanuga, di Special Adviser on Information and Strategy to Presido say dem don get di letter.
Nnaji say he don look di mata very well with he family members, associates, and even Nigerians wey get am for mind so nai make am say e beta make he kukuma step down.
For PREMIUM TIMES news paper side dem say di Minister tok say na pesin give dem N100 million nai make di newspaper dey yarn dust but di newspaper say na big lie.