Everywhere dey catch fire for social media cus of wetin US president Donald Trump tok about di way terrorists take dey kpai Christians like chicken for north and Nigeria govimet just dey do like say dem be bambialla wey nor dey see wetin dey hapun.
Naso Trump come tear serious warning give Nigeria president Tinubu, say as water don pass garri, US go hawk di mata for dem head as dem nor go watch make Christians dey karey kpai anyhow again.
Some pipo say make Trump dey he own S Nigeria na state of e own and Trump no go karey come dey show bodi say he wan epp plus notin like say genocide dey di kontri na both Christians and Muslims dey kpai.
Mata never drop reach ground di Special Adviser to President Bola Tinubu on Policy Communication, Daniel Bwala, say notin like Christian genocide for Nigeria and president Tinubu dey prepare to meet Trump make he tell am di koko.
Na only Bwala use he hand share interview video wey he do with BBC on Sunday for X say pipo just dey tok wetin dem no sabi but when di two president go sitdon meet di whole issue go clear and pipo go know say geneocide nor dey hapun for Nigeria but na normal killing of Christians and Muslims nai dey touch everybodi.
