+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Nobodi Dey Kill Christian For Nigeria, Trump No Mind Dem— Nyesom Wike

All di tok about Christian genocide na just wetin opposition leaders wan use take cus casala for 2027 cus dem nor get anoda strategy again.

Dis na wetin Minister of Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, tok on Monday for Channels TV Politics Today progam wey dem dey ask am kwestun on di mata.

Wike say na di pipo wey dem platform don fall for gutter nai dey beat Christian genocide mata come put am for
U.S Presido Donald Trump bodi so that do konrti go turn zigizaga for President Bola Tinubu administration.

Wey dem ask Wike futher nai he give example of wetin hapun for 2015 under Jonathan regime wey APC march go U.S go tell dem say pipo dey die under Jonathan govimet so that dem fit take power from di givimet.

Wike say notin like Christian genocide dey hapun for Nigeria so make pipo rest as opposition just want make everywhere dabaru so that dem fit take over for 2027.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM