Delta State don say dem nor go sleep until di State dey free from kidnap and oda bad tins, nai make di State Commissioner of Police, Abaniwonda Olufemi, come out tok again say dem don catch msny bad pipo , kolet dem guns and even moni.
For press briefing on Wednesday for Asaba, nai di CP say dem use information weu dem get from Force Technical Intelligence Unit (TIU), Abuja, take catch one Jamila Abubakar for Conoil Filling Station wey dey for Warri–Patani Road, Effurun.
Dem see N550,000 for Jamila hand wey she get from selling guns and ammunitions. From there nai dem lead to one 31 years Ahmed Ibrahim wey dey stay for Niger-Cat for Warri, he own bad cus na bandits wey dey North and oda bad pipo Ibrahim dey supply to and police don dey find am since.
Di kind weapon wey police see for Ibrahim hand no be small, he come lead police to one for Ughelli-Warri road bifor Beta Glass company, where dem see heavy machines bury for bush.
Police say Ibrahim hand dey for many kidnap wey dey hapun for Ughelli, as dem still use Ibrahim link and catch plenty odas of di suspect.
