+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

President Tinubu Ambassador Nominees List Get K-leg — Sam Amadi

Di pipo wey President Bola Ahmed Tinubu bring come put for weekend day na dem go represent Nigeria for outside kontri don get many bad mouth tok wey folow am.

Na 32 pipo wey don already get name for society nai dem name dey di ambassador list, like di foma INEC Chairman, Prof. Mahmood Yakubu; foma presidential aide, Reno Omokri; foma Minister of Aviation, Femi Fani-Kayode; and foma Enugu and Abia Govinor, Ifeanyi Ugwuanyi, Okiezie Ikpeazu join with plenty odas and dem don send di name go give Senate to check and confam.

Many pipo bodi nor sweet dsm like di Director of Abuja School of Social and Political Thought, Sam Amadi, wey dey tok for Arise TV on Sunday na na just politics president dey play and na how to pay pipo wey dey loyal to am.

But di Senior Special Assistant to President Bola Tinubu on Foreign Affairs and Protocol, Ademola Oshodi, don tok he own side say make pipo nor dey karey tok wetin dem nor know as di pipo wey president Tinubu pick na for di good of he govimet and di kontri.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM