Federal Govimet thru di Ministry of Humanitarian Affairs and Poverty Reduction, say dem wan epp 50 million pipo for Nigeria with moni so that sapa nor go finish dem as tins don tire wrapper wellwell.
Na di Minister Dr. Bernard Doro, nai tok so on Thursday for di National Council meeting wey dem do for Calabar, Cross River State, and say dem don already send 34 million to pipo but bifor di year go finish, dem go reach di 50 million target.
Di resin for di program na to reduce sapa cus Presido Tinubu know say tins tight for every kona.
Nai Doro com say President Tinubu nor just deg look nai make am start di National Council on Humanitarian Affairs and Poverty Reduction so that smile go reach everybodi face.
