E pass 70 pipo wey terrorist Boko Haram kill like chicken for two villages wey dey for Kwara State cus di pipo nor gree accept wetin Boko wan preach for dem.
Sources tok say di two villages, Woro and Nuku don dey notice Boko boys waka for di area bifor dem come send letter say dem wan come preach to di pupi to accept dem kind way of Muslim but di villagers say dem nor want.
Naso kasala take bust as 78 pesin kpuf, house reach ground, dem tiff more than 30 pesin and other dead bodi still deg come out.
Di state govonor, Govonor AbdulRahman AbdulRazaq, tok for X say na 75 Muslims pipo nai just die troway on Tuesday from di Boko boys hand.
Tori get am say na around 6:00 for evening nai di group take reach di village and dem raid for 3 to 4 hours even kill two of di king children and tiff di odas.
Presido Tinubu don sha send battalion of sojas to go Woro and Nuku village.
