+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

SERAP Dey Ready To Probe Senate Why Dem Change Electoral Amendment Bill

Tok don full everywhere about di Electoral Act Amendment Bill as pipo dey say di same wuruwuru wey dem do for Tax Reform Bill nai dem take play for di Electoral Act Bill.

Nai make di Socio-Economic Rights and Accountability Project (SERAP) write petition go give Code of Conduct Bureau make dem investigate members of Senate and oda public officers to know wetin make di Electoral Act and the Tax Reform Laws dey change like chameleon.

SERAP for statement o. Sunday say dem nor wan hear as jibiti dey di two process cus National Assembly nor give approval.

Di Deputy Director Kolawole Oluwadare, say make dem look some of dis senators well cus wetin all of dem go gada gree to do, some wey wayo dem blood, go use back take go change am.

But all dis one wey SERAP dey nack mouth put, Senate dey deny say dem nor komot one pin from di electronic transmission of election results, di only tin wey dem do na change English language of “real time” and na pipo wey nor know english dey drag too much.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM