+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Mirabel Di TikTok Rape Liar

Di TikTok girl, Mirabel, wey say somebody rape for her haux for Ogijo area of Ogun State, don laslas gree say na lie she dey lie.

Wey Mirabel post di story online naso plenty pipo come dey say dem must arrest di pesin wey rape her. Only for pipo to notice say her story dey get different mouth.

Naso police for Ogun State come join with Martins Vincent Otse (VDM) ask Mirabel kwestun sotay she confam say she dey lie.

VDM call Mirabel dey ask her kwestun nai she gree say na lie she dey and even di TikTok hakant of pesin wey dey threaten her online, na only she create am to match her story.

She come dey beg VDM, say she dey take drugs and her head nor koret di time wey she post di video.

One police officer wry tok on di mata say di DPO and some senior officers dey wifh Mirabel for hospital and dem go karey her go court afta she take treatment finish.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM