One hotel wey dem dey build for Jikwoyi, Abuja nai don fall on Gud Friday and many pipo dey inside wey di building fall.
Pipo wey dey waka pass as dem see di building fall, rush to go epp di wokas wey dey for di Ugo West hotel.
Pipo wey use eye see say di building just fall like say pesin push am and di wokas just enta grand like dat. Dem still dey wait for emergency to come epp bring di pipo out.
