+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

FG Don Porchu Alex Komot Nigeria Cus Of Tok

Fediral govomet don porchu Alex Barber di hamerikana foot ball player wey come turn to missionary, make he karey bag komot from di kontri say he tok dey add fuel to fire for North.

Alex dey work with one hamerika NGO and he epp build haux for Yelewata afta bandits go kpai and burn haux there and he still dey epp pipo for Plateau State.

But gbege come dey show as Alex go dey blast govomet nai dem say he nor dey tok well, make he komot from Nigeria bifor he go put more kerosin for North.

Na Abiodun Essiet, di Senior Special Assistant to President Bola Tinubu ontop komuniti Engagement for North Central nai confam for TVC day dem don porchu Alex cus of toktok.

Dem say dem don see wetin Alex do to cus division for di kontri nai make dem remove am.

Essiet say afta Alex tok for Jos nai dem kill two Muslims so he tok dey make pipo vex, nai make Nigeria porchu am komot.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM