+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Why We Sack Sojaboi – Harmee

Afta di video wey foma Lance Corporal Rotimi Olamilekan, aka sojaboi do wey make Harmee sack am, harmee say e dey lie say na only him dey buy uniform and tins to take fight.

For wetin harmee Acting Director of Public Relations, Appolonia Anele tok, dem say all di tins wey any soja nid to take fight plus dem salary dey go on normal.

But even dou say harmee dey give sojas wetin dem want, Anele say some sojas dey use dem own moni buy tins for dem own kofort dat one not mean say harmee system don kolapse.

Harmee come say di main mata wey make dem even sack Sojaboi na cus he go hagaisn harmee rules of social media nor be cus he tok he mind.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM