Police say dem don harest Pam Joseph, di pesin wey make video dey spread news say terrorists dey every kona for Abuja and dem dey hatak pipo.
On Friday police say di video wey dey trend na heavy lie cus na video wey Joseph karey from difrend place nai he join togeda to make pipo wey deh Abuja dey fear.
Dem say pesin fit tok wetin dey he mind, but nor be to do am to make pipo dey fear and di news sef nor be true but na just to shake di kontri pipo peace.
Police don put Joseph for cell and go soon send am to court but dem come still draw ear tell pipo say, dem eye dey look wetin sup for social media and any pesin wey dey do anyhow hand go touch am.
