Kidnapa don tiff di Local Govomet Chairmo of Sapele, Chief Bright Abeke, for one hotel wey dey near Owumi Road around 7 on Friday evelin.
Dem day di kidnapa reach 15 and na Range Rover and two oda moto nai dem take enta, dey shoot to make pipo run hide.
Wetin pipo wey use eye see tok say, di kidnapa just enta di hotel karey di chairman go but gun touch one vigilante man wey be Ufouma.
Di mata don reach police hand and dem dey try to find di man but to enta and komot from Sapele come hard now as security full grand.
