Govomet of Borno State say Operation Hadin Kai wey NAF do for Jilli area of Gubio LGA on Saturday, April 11, 2026, nor be hagais any pesin cus dem don warn pipo make dem nor dey sell or epp Boko Haram.
Gov Babagana Umara Zulum, tok for paper wey hin Special Adviser on Media, Dauda Iliya read say Jilli Market na place wey boko boys take dey get supplies and dem don even klose am for five years now.
Jilli dey inside Gubio LGA for Borno State and still join leg reach Geidam LGA for Yobe State, and di komuniti don dey for bad list join with Gazabure market, nai make govimet klose am down.
Di paper say Borno and Yobe States dey tok back to back and dem dey resin well with military and oda sekurity to know wen dem go open komuniti wey nor dey settle so any pesin wey karey leg go dose place dey on he own.
