Consulate General of Nigeria for Johannesburg don send message to Nigeria pipo for South Afrika to stya away from di protest wey dem wan do hagais forinas today Monday, May 4, 2026.
Na around 10 and 11 for morning nai dem go karey di mata for head and na for Mary Fitzgerald Square for Newtown nai di South Afrikans go gada to take step.
Na di Consul General of Nigeria, Ambassador Ninikanwa Okey-Uche, on Sunday, nai deg warn say make pipo dey alert as na both who get paper and who nor get paper nai dem wan face.
Dem come still tell Nigeria wey get business make dem close market for now and make dem nor go dey fight for right.
Di consulate get put mouth afta South Afrika say dem go protest for di nine provinces wey dey di kontri.
