As police don sack orfica Nuhu Usman and teree odas wey join go karet kpai Oghenemene Ogidi for Effurun, dem case file don reach Attorney General of di Federation hand to karey go court.
Na on Sunday nai di Force Public Relations Officer, DCP Anthony Placid, tok for Force Headkwata, Abuja say afta invesigation dem see say Nuhu and he gang nor try at all.
Force PRO say na from Yenagoa, Bayelsa State, nai dem send di package come give Mene, den he wan send am to Sapele wey di park take check see say na english and groundnut dey inside.
Police say dem still dey try to catch di driver wey karey di parcel from Bayelsa come Warri and oda suspects, plus di two vigilante wey dey wen Nuhu dey lite Mene.
