Federal High Court don fix May 8 as day wey dem go take judge kase say make foma President Goodluck Jonathan nor come out to contest for 2027 election again.
Di lawyer wey karey di kase for head na Johnmary Jideobi, and he say with how di law of Nigeria tok am, Jonathan don complete he time of president cus wey Yar’Adua die, nai he rule finish and still come win for 2011.
Di lawyer say make court just look di mata so dat peace go dey cus e nor go good make Jonathan join party as political party fit even drag am take, so make the action start now. Den di kase na still to stop INEC make dem nor take Jonathan.
