+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NNPCL Get Wetin Dem Dey Hide Wey Dem Nor Wan Tok -Atiku On Why Chinese Kompani Go Run Warri, Port Harcourt Refineries

Nigerian pipo make una shine eye o cus na spoil nai NNPCL wan spoil Nigeria refinery but dem dey lie say dem don give am to Chinese kompani to handle, wetin dem nor fit do afta millions of dollars nai dem wan hide karey put else where.

Na wetin foma VP, Atiku Abubakar, tok about di two Chinese kompani wey NNPC just sign kotract with, say dem nor get di pawaa to do di work cus nor be wetin dem don do bifor.

Atiku tok for statement thru hin tokpesin Phrank Shaibu on Friday, say na just secret NNPC dey hide as Sanjiang Chemical neva do crude oil refining bifor come even say na Warri and Port Harcourt refineries wey big.
While di seconf kompani Xingcheng (Fuzhou) Industrial Park Operation and Management Co. Ltd., na dem own even worst cus noting like say dem even konect to production as na hospital tins, real estate development and building nai dem dey do, so wetin make NNPC sogn kontract with dem nai dey wonder Atiku.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM