Nigeria online olokpa and media critic Martins Vincent Otse, aka VDM, say he don really ready make govimet karey am go court cus of di wey dem say he do to leak audio of President Tinubu.
For di fake video, President Tinubu tok for audio say nobodi vote am so he go use insecurity suffa pipo, kolet moni and even call Peter Obi to step down for am but he nor gree, so anytin wey dem see make dem take.
Naso di video spread sotay Bayo Onanuga, Presido Tinubu media aide, come tok say presidency nor go allow dis one slide as wetin VDM dey find he go get am.
Nai VDM do video troway back sah he nor go defend hinsef and if he ansa dem make God punish am. Say he ready to face di law and go even come quick to see wetin dem wan do.
“If e dey pain you say VDM dey tok, wetin o get to do? Na my right to tok if govimet dey mess up. Na democracy we dey,” Na wetin hin respond.
