+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Teachers Strike For Oyo Till Thy Kingdom Come-NUT

Strike wey dem no know wen e go end nai di leaders of Nigeria Union of Teachers for Oyo State tell all di remaining teachers for di state say if di shidren and teachers for Oriire wey bandit tiff nor come out make dem nor go skool.

Na from June 1 nai di teachers go stop to teach and on Tuesday June 2 all of dem go gada for di state to march protest and karey am end for govimet haux. Na for statamet wey di NUT National President, Comrade Audu Titus Amba, and Secretary General, Dr. Clinton J. Ikpitibo sign togeda nai di info dey.

As Oyo dey like dis tension dey rise like Ijebu garri come join with di videos wey di yeye terrosists relase of how dem dey kpokpo di poor shidren inside bush while di teachers dey beg state and FG to come beg di terrosists.

Rumour don dey fly say some of di shidren fit don leggo nai make di union say dem nor go gree as skool suppose be safe place but e don turn to anoda tin therfore, if di shidren and teachers nor come out, di strike go dey till thy kingdom come.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM