+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Five Hufica Wey Kpai Mene Court Send To Prison

High Court for Asaba don send five police hufica wey dem hand dey for how Oghenemene Ogidi take fall, to go Ogwashi-Ukwu prisob till di kase go finish.

Di hufica na, ASP Usman Nuhu, 42; ASP Onoloko Dauroupamo, 47; ASP Okoh Kelechi, 46; Inspector Goodluck Kingsley, 42; and Inspector Omonigho Ahweyevu wey be 41yrs nai dem bring come Asaba High Court 5 but dem karey di kase to June 15th afta di legal advice from the Directorate of Public Prosecutions (DPP).

Wey di senior broada of Mene dey tok, Victory Ogidi, he say dem nor like as police nor dey give di family update as na social media dem take dey hear tins. So e go beta make di State Attorney General of Justice Ministry and the NFP come out open to di family cus even di court kase, dem nor allow jornalist even enta di court.

Furthermore, social activist Harrison Gwamnishu come still say he like as dem karey di police to court but say di way info dey flow to di family nai nor make sense.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM