+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Hares Woman Wey Fake Her Kidnap For Delta Hotel

Di young woman from Canada (Anita) wey she and her siblings come out dey beg for N50 million make dem use pay kidnapa wey tiff her mama for along Ikpoba Hill, Edo State, don come out again as police don see di mama.

As police involve for di kidnap kase cus di kidnapa first say N50m but come reduce am to N20m naso police come enta di mata only to discover say na fake kidnap.

Di lady mama name na Mrs. Oluchi, and na hotel for Ubiaroko, Delta state nai dem gbam her as she dey chill with her boyfriend but dey lie for family say she dey with kidnapa.

Di pikin for Canada, Anita, don say her hand and family nor dey for wetin her mama do cus na disgrace she karey take rob dem for face, so make law do wetin dem like.

According to her all of dem shock say dem mama fit behave like dat, say even her papa nor top well but see as di mama don disgrace di whole family.
“My mama don skata my name. I nor even know wetin to tok. I just dey vex. My hand nor dey wetin she, na just pikin wey dey cry to epp mama nai i do, make police do dem work,” dat na wetin Anita tok.

Even di mama meeting group for WhatsApp don write say, di leg wey dem member throw dem nor know about am and no bodi join am for dat kind yeye waka.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM