+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Kidnapa Dey Wan Tiff Shidren For Edo Skools, DSS

As tori come out say terrorist dey try to kidnap skool shidren for Edo North Senatorial District, di govimet don close down teree skools.

Na DSS for Edo nai raise di alarm afta dem get info of di hatak for wey terrosist dey plan for Ososo Grammar School, Ososo Comprehensive High School, and Makeke Secondary School, all of dem dey for Akoko-Edo LGA.

Wey di Permanent Secretary of Ministry of Education, dey tok thru di mouth of Enodolomwanyi Otamere dem say nor be pamanet close dem do but for di main time but for dos wey dey write WASSCE, dem go finish dem exam with beta security for ground.
Di state govimet come say make pipo nor panic as dem dey provide security to make harm nor touch anybodi.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM