On girl wey be Chinaza don leggo for NPA water as dem canoe go jam anoda engine boat for di same water.
Chinaza na just 19 years and she join pupi wey dey travel from Sandfill II bifor anoda engine boat come jam dem own boat.
Pipo say one 7 years wey dey inside di boat with hin family members swim come out from di water but dat one nor be di kase of Chinaza wey nor sabi swim.
Di friend of Chinaza wey dey di boat, Favour, say di driver of di boat wey jam dem don report hinsef to NPA marine police and dem don haress am while fishermen divers still dey finjld Chinaza deadi bodi for di water.a
