Di mouth wey dem take tok about say Odua Peoples Congress leader, Bayo Fabiyi don enta kidnapa den as he dey go give dem N30m as ransom for pipo wey bandits tiff, dat same mouth don change to anoda version of story.
Na on Monday nai tori land say Fabiyi karey M30m dey go give di bandits for bush with two oda pesin bifor bandits kidnap di saviour for Oke-Irese kominiti wey dey Irepodun LGA for kwara state. And dis one na afta dem say make di leader add 5 okada and teree bag of rice join.
Pipo don tok tire but di state police commissioner, Ojo Adekimi, and di Coordinator of Kwara South Joint Security Network, Comrade Zubair Olaitan say nor be wetin hapun be dat.
Di CP say na only N2m nai di OPC leader karey and nor be N30m as pipo dey tok and dem nor even ask for 5 okada and teree bags of rice as one of di OPC leader shidren claim.
