Belike many pipo go kpai for di teree storey building wey just fall for Alakija side for Lagos, cus plenty of dem still dey under di building.
As e dey now, dem neva know di nuna of pipo wey dey inside and wetin even make di building kolas.
Pipo just dey try wan epp di part wey dem fit but Lagos State emergency responders qan start to dey bring di pipo come outside from di kolas building.
