Presido Tinubu don send anoda name of pesin wey he want to be ambassador go give Senate on Wednesday to make di man non-career ambassador/high commisioner- designate.
Na on Wednesday nai di letter wey Tinubu send say make dem put Professor Abayomi as ambassador according to wetin di law tok.
Na Senate President Godswill Akpabio nai read di letter for di haux as President Tinubu say di mata dey very urgent and e go good make dem confam di professor sharply without any delay..
