One very bad and stoborn bandit leader don dey nak chest say he fit kidnap top govimet hufica and even state govimet and notin go hapun cus he dey get beta info from military even bifor dem hatak.
Na for one audio wey dey waka for X nai di bandit leader Kachalla Maha take dey shout say make govimet free hin men and di nama wey dem sieze, say he don tell dem tire dem no wan hear, so he go show dem peper amd go tiff plenty pipo cus he don already mark he target.
“I ask una why una hares my men and Aminu. Since una say una nor go relase dem, e nor kwasen me if una send tausan soja. I never tire o, and i nor go tire until i kpai, cus i fit kidnap anybodi even state govinor.
“I swear to Almighty God say all di security forces wey dem send come hatak my camp na my boys. Dem dey tell me when dem wan come. I dey hear all una security strategy, even di one wey kwasen Presido. Na becus i dey allow dem operate if not dem nor go even fit use ordinary road,” na wetin bandit leader dey vomit.
