As South Afrika dey dem dey do xenophobic and nor wan use eye take see any pesin wey hin sixk black and nor be from dem kontri to vamus and pipo don even kpai ontop. Di state visit wey President Cyril Ramaphosa wan go do for Ghana dem don tell am not to come.
Ghana say dem don return like 1000 of dem pipo and 900 pipo don register to come back but di relationship with South Africa don scatter as for di June 30 march for march waka south Afrika pipo kill one 40 years Bashiru Isak.
But South Afrika dey deny di mata say werin Ghana dey thunk nor be so e hapun even di Justice Minister, Mmamoloko Kubayi, say Ghana just dey paint di mata too black to give South afrika bad name.
So as e be now di visit of Ramaphosa to Ghana nor fit work cus Diplomatic sources for Accra and Pretoria say bodi don already dey peper Ghana and dem nor fit risk to cus problem for di kontri cus South Africa President wan come.
