+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Kidnap Mysef To Kolet N25m From Family- Edo Man

One Edo man Micheal James but dey stay for Delta State nai police don hares cus only him plan kidnap to take kolet N25m from hin family afta he nor fit pay moni wey he borrow from he broda and sista.

Wey James dey tell police how he take plan am, he say dem send am to go troway dirty on July 1 but instead of am to go haux nai he leave di wheelbarrow for road enta bush.

Afta some time nai James call di mama say kidnapa don kidnap am and dem.dey ask for N25m but later he say dem don beat am tire nai he give di kidnap N700k. Di mama come tell am say police don dey come to save am, but James enta Okada change location.

When he don reach di new location he call di mama say he escape from di kidnapa but dis time police don reach di new location.

SP Bright Edafe tok say as dem reach di location naso James just run come out from di bush like who dey dem porchu but later confess say na hin plan everytin.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM